Matters Arising
Matters Arising is a platform to raise issues affecting our people with a bid to proffering Solutions
07/09/2026
Still on our 39 at 39!!!! The Political Adviser to the Governor of Akwa Ibom State, Dr. Godwin Ntukudeh don ready to siddon on top this Monday Morning. Since September 1 na e the Akwa Ibom State Government don shook leg for road begin celebrate 39 years of the state, but e still reach to ask, How Far the government don waka to beta the people life, how these projects dey affect the people sef? where we dey go next for the waka to 39? Tune in to on Inspiration FM 105.9 today at 11:00am to get answers to the questions on Matters wey concern we everyday pipo!!!
31/08/2026
Welcome to this Monday Morning, as una sabi say we don enter the Campaign season ahead of the 2027 elections, and for we Akwa Ibom State; the Christian Youths na the first to endorse we Governor; Pastor Umo Eno. Special Adviser to the Governor on Religious Affairs; Rev. Dr. Nduese Ekwere na e be our guest today for , Wetin be the reason for the endorsement? Church people suppose shook mouth for Politics? Wetin this endorsement mean ahead of 2027? Tune in to Inspiration FM 105.9 from 11:00am, for
24/08/2026
My Contri Pipo, Una Monday-Monday tonic don show again oh, as una sabi say when matter concern we people, na for head we dey carry for .
The Akwa Ibom State Government declare another phase of food distribution for we state, plus some kain empowerment for the less privileged for we society, and na the Ministry of Humanitarian Affairs na dem siddon gidigba dey monitor as the food and things dey move, local government to local government. Na why we wan ask them say, wait oh, wia una don share dis food reach? who be the people wey the food dey for? who never collect and when e go reach their turn? wetin be the other Humanitarian efforts wey this government don put for ground?
Dr. Pam Pam go siddon with Princess Emem Ibanga wey be the Honorable Commissioner of Humanitatian Affairs for Akwa Ibom state, and the General Manager of the Food Intervention Agency; Hon. Unyime Etim, on top Inspiration FM 105.9 from 11:00am for No Miss AM!!!!
24/08/2026
We are LIVE!
17/08/2026
We Contri Pipo, Amesiere oh! Monday Morning don come and na so we sef don load fresh episode of come. As you sabi say, every corner wey Akwa Ibom State Government enter with policy abi na development, we dey to torch-lite am, ask the kweshun of how the people take fit benefit, as we sabi say na Government of the Pipo, by the Pipo and for the Pipo na e we dey for we obodo Nigeria and we state.
Today, nah the Youths we wan siddon follow talk, the Commissioner for Youth Development for we state Dr. Ekerette Ekanem na e go sidan gidigba inside Inspiration FM 105.9 studios from 11am, to give updates on which projects and policies dey ground from empowerment go reach job creation and even the Youth centers wey e tell us the other time, how far we don go? how many local government don dey use am?
No siddon look oh, tune in to with Dr. Pamela Chima Akpomedaye, make you for sabi wetin dey your dormot, as our own nah to carry matter wey concern everyday pipo come.
20/07/2026
Contri Pipo! Dis Rain na wah oh, morning afternoon and night, na so so rain dey fall.
But come oh, rain self na bad thing? shebi na the season we dey, abi na the flood we pipo dey fear?
Nobody like make water come carry e house and property at all oh, plus dis one wey NiMet and Hydrological Agency pipo dem don talk say the rain just start so.... wahala!
Na why we rush go find the Chairman of Akwa Ibom State Environmental and Waste Management Agency;AKSWEPMA, Hon Prince Ikim wey we don see dey waka from street to street, gutter to pit around the state, make e come tell us wetin the agency dey do to protect we pipo, plus wetin we as the pipo sef must do to protect we environment, make we all for dey alright.
Tune to Inspiration FM 105.9 from 11:00am, as go dey LIVE! to torchlight the Environment and how Akwa Ibom State Government dey protect am. Join us!!!
13/07/2026
The Akwa Ibom State Government say dem don start the Phase 4 of the Free food distribution Programme for inside we state. Many people still remember how the complains dem many when this project start, but now, the Government say dem get better way to do am, how dem wan carry do am this time around? tune in to as the Oga for information for inside the state Hon. Aniekan Umanah go share information on top this matta. Inspiration FM 105.9 na e be the station wey we dey on Mondays, no miss am.
Click here to claim your Sponsored Listing.
Category
Contact the business
Website
Address
Uyo
23401
Alerts
Be the first to know and let us send you an email when Matters Arising posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.