Ughelli Aproko Gist

Ughelli Aproko Gist

Share

Ughelli Aproko Gist Na Where We Dey Bring Una First Hand Aproko Gist.

Photos from Ughelli Aproko Gist's post 13/06/2026

Current situation of the road by corner of stadium when lead to slaughter.

According to our source, na since morning at about 4:am nai the tanker get accident for there with another tanker .

As dem dey battle that one nai this one wen carry heavy machine spoil for there but as we dey hear now dem say one don comot .

13/06/2026

Once an actor, is always an actor....Those ages before taking any role in nollywood, you have to pray and fast very well so that the role won't affect you spiritually, it's obvious Kenneth needs help, the spirit of Living in bo***ge has finally caught up with him. And we know what the holy book say when one demon is being cast out, when it returns and find the place vacant, it goes back and come back with legions.


Una happy weekend oooooooo

Photos from Ughelli Aproko Gist's post 10/06/2026

The Department of State Services (DSS) don alert Edo State Government say bandits dey plan to carry out mass kidnapping of school children for the state.

As we dey hear with one ear now say Edo state government don close schools cos of this uodate wen DSS give them.

Delta State Government make una sit tight cos edo and delta na twin states and na water wen touch penñîs nai touch brokos ooo,

10/06/2026

Update On The Issue Of Oghenemine When Ogbegbe Kpai.

Police don successfully track and parade four people when know and link to the g^n matter.

Make una nor forget say the former police officer wen shuuut Oghenemine kpai wen dem dey call Ogbegbe and four others don dey Ogwashuku prison.

We dey use this medium to commend Nigeria Police Force for this one and also to beg dem make dem also track those b@nðIt and HeRďsmen wen dey worry the country.

Photos from Ughelli Aproko Gist's post 09/06/2026

Our local government chairman don pay one woman rent for ughelli oooooooooo.

According to the story, the woman wen her name na Mrs Elisabeth Christian na originally from benue state.

Na the Senior Special Assistant (SSA) on Special Duties to the Council Chairman, Emuophedaro Igho nai represent olorogun Egbo and he pay the house rent directly to the woman landlord.

09/06/2026

Truck Wen Dey Go Deliver Cooking Gas Nai Jam Marvel International School Bus This Morning For Agbarha Junction.

As we take hear am be say the tanker fail break, na so he carry the marvel school bus dey vuuuuuuuu until the pavement hold am and thank God say no single casualty.

Children really dey innocent for this life .

09/06/2026

From our inbox:
Good day sir abeg help me post i need vacant self contain apartment for ughelli here and i nor know any agent please help a sister thanks.

09/06/2026

One defendant try to escape from court yesterday. Di man talk say e wan go ease himself, but he real plan na to escape through d toilet ceiling.

Police officers wey dey wait outside d toilet no see am come out after some time, so dem begin call am, but e no answer. Dem rush enter search d restroom, but d man don disappear.

Na so dem threaten say if e no come out from where e hide, dem go shoot. Na then d guy man climb down from d ceiling come surrender.

Na this one we dey call double wahala for ðëDu body, as e b like this so he go face other charges join initial one .

Photos from Ughelli Aproko Gist's post 08/06/2026

Madam, as u block everybody from reaching you so, use ur mind take come inbox make we reason the matter like family matter before we all go dance naked for market square.

Who know her, who know who know her, make una help us tell her to come DM asap.

Una dol ooooo

08/06/2026

A message from his excellency, the Governor of Delta state.

He say he dey work but he nor sabi make noise say nor b chochocho.

Una happy new week .

Want your organization to be the top-listed Non Profit Organization in Ughelli?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Website

Address


Ughelli