Adecanwrite

Adecanwrite

Share

Story telling (fiction & comedy) Video Skits, Content creator, Script writing

23/06/2026

(SNIPPET)
β„’
Ade enter bathroom, open shower. As the water dey beat him body, he come feel used. Even though he enjoy the panashuku, he still feel like say she dey use her. Because now, he go need to dance to the tune.

But, to be candid, wetin Titilope talk na true. As long as she no show greediness, he go make money. Sebi na just one year, make e do finish, gerrout go start new life with him sister.

As he dey there under the shower, he don even think go, he feel am say hand dey rub him back. He startle.

"It's me" Titilope talk calmly.

Adedapo no turn. He just stand there, drop him head. Titilope begin use soap rub him body, raise him hands up, scrub him armpit, and everywhere. She come begin bathe him. After, she come give Adedapo the soap make he baff am too. Adedapo collect the soap, do the same

After them baff finish, both of them clean up. She give Adedapo new clothes come drop him NYSC uniform and footwear for the laundry guys, for washing.

They return to the dining to eat. As dem dey chop, the king call Titilope say make dem come.

After they pay obeisance to the king, they sit. Then one man wey wear suit, wey dem meet for palace, wey sit down, begin talk.

"Na me be lawyer Okeowo. And the reason why you come here na to sign some agreement papers, concerning the service wey you wan dey render the king. A service wey go dey discreet. U no fit tell anyone about it aside we wey dey inside this room. You understand? You get any questions before you sign the papers"?

"You talk say ano fit talk to anyone else about the service aside we, wey dey inside this room"?

"Yes, na wetin I talk be that"

"But, what about the leader in Arinlu"?

"Yes. He dey with us. But, you no need to discuss anything with am. Na madam Titilope you go dey report to, not him. You answer to her, she answers to the king"

"Okay sir"

"After you sign the papers. We to put you tru some things wey go guide you in carrying out your service"

"Okay sir"

"Are you ready"?

"Yes sir"

Lawyer Okeowo open his bag and bring out some papers. He hand them over to Adedapo.

"Take your time to go tru it, very well"

Adedapo begin read tru gently. Na just one page. Wetin dem write there na say he don agree to keep his service discreet and he go dey kolet 40% cut from everything wey him bring to the table.

"Please sir, I need pen"

Lawyer give Adedapo pen and he sign. After he sign, the lawyer come tell am say, as a new comer, say e get one small ritual wey iya Orisa go do for am at the shrine. Say when he reach there, he go see the diamond. Say make e know him way to and from the shrine on that first day. Before the next time, he go go alone and na to go pack diamonds. Say, the diamond no fit finish anytime soon. Na every Wednesday e go dey go there go take diamond. So, e go go atleast 4 times a week.

Na only Wednesday he fit go wey nobody go see am, because dem dey go one carnival wey be like ritual wey all of them dey gather for the village square do. And na everyone dey dey there. Na the only time wey he go free be that. He fit decide not to go or join them later since he no be indigene.

Thw orientation wey dem give am, enter him head.

"Please, no try to play smart. If you do, you go get problem with us"

"Yes sir"

After that, Adedapo come present the list of things wey dem need at the clinic to the king. He just tell am make he give Titilope, say she go provide everything.

When they walk out of the palace, Titilope talk "You did good. Weldone"

"Thank you"

"You are welcome...so, you wan return to Arinlu, today"?

"Yes, I plan to"

"Ade...stay today, ago drive you go myself tomorrow. It is late already"

"I think say na tomorrow you go get the things wey we need for clinic"

"Even the carpenter and the bricklayer, plumber and painter? No. Give me a week and everything go set. Your clinic go resume. But, give me today"

"Okay"

Titilope spoil Adedapo that night. From drinking, to eating, to doking. Dem doke taya before daybreak. Titilope happy dye.

Around 10am after them chop breakfast, Titilope drive Adedapo back to Arinlu.

Na the clinic she drive am go straight. The place dey empty but e dey neat. E show say dem don come clean am, that morning. Adedapo come check him bag for the corper lodge, see say e no dey again. He tell Titilope say he no wan stay for Leader house again.

Titilope talk say he no geh choice, say the lodge never return to accomodate anyone. She come drive am back to Leader house. As dem park like this, People don begin peep. Both of them come down from the car, go greet leader. After, Titilope go. Leader tell Adedapo make e go inside go change. Say dem go talk later.

Adedapo sha manage find him way back to Abeyie room. When he enter, he meet Abeyie for one corner of the room, dey play with one small doll, like small pikin..and she look very dull.

Adedapo think say she know say she don enter. He come stand there dey look her.

"Abeyie"?

Abeyie look up. The moment she see Adedapo, she fling the doll, jump up, run and jump at Adedapo. Adedapo stagger and both of them land on the bed...

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite

22/06/2026

One evening, I meet one preety lady for my area when I go chop for one Buka. She look young and she fine! I see bobbe wey full, I fΓ³. I collect number, we begin chat.

I come ask her say make we meet. She say she no dey get chance to comot, say unless if I fit come. Sometimes, I dey hear say pikin dey cry for background. I been wan ask, but I just say, wo, maybe she dey live with her sister.

One day, I come disturb her again say make we meet na. She say if I fit come her house. I say ah, ah no dey do am. She say iffa no come, say we no fit see. I come say ah, maybe if I go, ah fit see free pongila.

Naso I go oh. When I reach the address, I call her. She say she dey come. Naso she peep from gate, say make I come quick. She fess look different from wetin I dey see before. She look like say she never baff. Her hair dey unkempt. I no come see the breasts wey dey freak me. The breasts don reach her belle. I do πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡ wha da sheeet! Wha apun? So, na bra?!

Naso she say make I dey come. She come dey walk fast. I come dey keep pace. I look her backside again. Ah ah? Why the yash come form love shape like this? Be like say moto jam am! See contour everywhere! Ah ah! No be wetin I see before be this na?

As we dey near the building, naso I begin hear say baby dey cry.

She enter house. I first stand for door. I come dey think am say, wetin dey apun for here?

"Ademi, come inside now"

Yee? Ade e keh? Naso I off palm, waka enter. Oh boi. Everywhere just scatter. Naso I see the babe dey breastfeed baby. I do πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡"Wha da foking sheeet!" See the breast! Wha da sheeet! Longttro breasts! Ah ah? Which kain bwest be this! Fear catch me. Na breasts for adults no be for my set! Omu awon agba.

Na married woman I visit? I begin scan all the pictures wey dey wall, maybe I go see her wedding pictures. E be like she don read me. "Ade, I am not married oh. I be single mother. Na twins I born. Dem be 1year plus"

I do πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡mmmm!

Na that time I come see say another one dey for sofa. That one dey play.

"Moku oh! Wha da sheeet!"

"Ade, sit down now"

Naso I sit down oh. As I sit, the one wey dey chair begin cry.

"Ade, please, help me carry her now"

For my mind, "Mogbe oh! Ade, baba baby! Kare! Akiika!"

I fess dey look. I come confuse. Well, make e no be like say ah hate babies. Naso I carry am. The baby no cry again oh. Naso she begin look my face, dey giggle.

I say "Shuuu?

"My dawta like you oh"

For my mind, I be like "Just dey play"

"She like you, Oloun. Ade, no vess. Iffa tell you say ah be single mother of twins, you no go come. Na these babies no dey let me comot oh. Na me and my sister dey stay for here"

I say "hmmm"

"Ade, I don dey cook for you. Make I go check am"

Naso she stand, enter. Baby still dey my hand. Naso she begin cry again.

Naso I say make I play with baby oh. I come raise am up. Dey smile to the baby. I go bring her face close to my own, use my forehead tickle her cheek, she go laff, me sef go laff.

As I do am the third time, naso she laff, belch "huuuhur!"

Na that time, I "de'tele" (open mouth) dey laff yeye laff.

Omoh, naso this baby vomit ogodo (baby vomit) direct inside my mouth...propoto!

The thing enter my throat straight! I fess do πŸ‘‡ πŸ‘‡ πŸ‘‡ (picture 2)

"What da vomit sheeet!"?

E be like make ai dye!

To be continued...

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite

22/06/2026

β„’

πŸ™πŸ™THIS IS RATED 20+

Adedapo look stunned. He no believe am. Adijat don dye keh? He no first know wetin he go talk. He fess dey look.

"Abeg, step out of the room"

"Abeg, make I carry my phone and my documents. Na corper I be"

"We are not blind. We see say you be corper. But, carry your things, make we dey go"

Adedapo pick up his phone and the paper wey he list things needed at the clinic. He put them for pocket and walk out of the room. The police walk gently after him.

Adedapo dey think am say, how dem know say he dey with Adijat? How? Who find out? Abi pesin see her when she wan enter? Shey Titilope go come gree make dem carry am go, just like that?

They reach sitting room. Adedapo see say Titilope sit for sofa dey cry. Two policemen stand behind the sofa while one sit beside her.

"Ehhh!? Na big case like this? He don enter one chance" Adedapo think for him mind.

"Sir"? One of the policemen wey dey Adedapo back salute the one wey sit beside Titilope.

"Take him away" he reply.

They lead Adedapo out of the room. For him life, he never enter police van before. He enter this time around. The journey to the station na quiet one and bumpy one. The road no good at all.

When they arrive at the station, they lead him inside an empty cell and lock him there.

Adedapo first look at himself. He first be like dream. He dey cell keh? From corper shaun to cell shaun, wha da sheeet!

What if he no fit prove say he no know anything about her death? No be the end of him life be that? Ehhh, Osanobua ehh!

He sit for one corner of the room and sigh deeply. He start to dey reminisce how he enter the town and everything wey don apun to him and all the things wey e don see since he arrive. He even remember as he knack Adijat. He enjoy am make he no lie. But now, see wetin e don cost him.

Adedapo dey inside the cell for over two hours before two men arrive with one other policeman. The policeman open the door and ask Adedapo to step forward. Adedapo stand up, walk to them and they lead him out of the cell to an office. They ask Adedapo to sit down.

"Corper Ade"

"😒 Sir"?

"You wan serve your fatherland abi you wan serve jail term, choose"

"My fatherland, sir"

"Good. Incase you don't know, we go charge you for murder or manslaughter. And you go get atleast 6-7years, minimum"

"Ahhh!"

"Yes. Because, na you Adijat dey with last, before we find her body. Na Miss Titilope find the body"

"😒 Sir, I don't know anything about her death. I swear"

"Are you sure"?

"😒 Yes sir"

"Then, why you invite her come your room"?

"Sir"?

"Answer the question" the second man interrupt.

"Be..cause I like her"

"Na lie...why you invite her into your room"

"I like her...and... actually, na she fess tell me earlier say, incase I dey lonely, say make I call her. So, when I dey chop, I come reason her say, make she come spend time with me,later"

"And when una dey together, wetin you tell her?"

"Nothing...I swear...we just make out and she go"

"Mmm...you still dey lie "

"Ano lie sir"

"Sharap! 😑 You think say we dey follow you play? E be like say you want make hand touch you. I go beat corper comot for your body, na Ade go remain..you dey craize!? 😑 😑

"So..sorry sir"

The policeman stand up angrily and bring out a blabla. "You dey craize?😑why you dey lie"?

"Calma calma" the first policeman calm the second wey comot blabla. Corper, we wan help you, buh you wan use your own hand take do yourself"

"😒 😒 Sir...sir...Can..I talk to Miss Titilope? Please...please sir..."

"Talk to us..."

"😭 😭 Please sir...make I talk to her..."

The policemen look at each other. One of the policemen walk out of the room. The other one walk away from Adedapo and stare at him from where he stand. Silence fill the room.

After about ten minutes, the policeman wey comot, return with Titilope. She look sexy and elegant in a simple gown. When she enter, the policemen nod their heads at her, exit the room and close the door. Titilope cat walk to Adedapo and sit on the table. She cross her legs wey be say her fresh laps come dey show. Infact if Adedapo bend head small, he go look thru the space between the laps, dey see her pant.

But Adedapo mind no even dey that one. Him mind dey troubled. See him, see prison! From service to service. Infact both service get uniform. Just be say, the latter one na 7-8 years with hardwork 🀣 wha da sheeet!

Adedapo no even know wetin he go talk. He just drop him head and tears dey flow down him cheeks.

"So, you...feel say Adijat deserve to grace your bed, than I...me? Me? 😁 You dey look down on me"?

"😭 No"

"Wetin you come do"?

"😭 Am sorry"

"You no even geh mind, and you dey chest wahala...abi"?

"😭 Am sorry"

"Raise your head and look at me like a man"

Adedapo refuse.

"So, you get mind, sleep with Adijat, instead of me...Ade, I put am on a platter of gold, for you. You reject me...me!? You know people wey dey fok me?ehn? Ade? Because I fΓ³ for you? You even lie give me say you no nack anyone for that village...how I go believe you now, wey you fok ordinary maid!"

Adedapo raise his face to look at Titilope. Tears dey drop down him face, to him beards. Titilope heart skip. Gosh! Na this guy go end her life. She wet at once. Him face dey wet, her own kpekus dey wet...what da wettery sheeet! Goosebumps hold her for everywhere. God, this guy fine! A perfect finey! Her crush! Her kind of man. She fess shut up. The thing wey she wan talk, return inside her belle. She just open mouth dey stare at him. Her body shake. Why on earth will she make him shed tears. She don do too much oh..Chei! Ebubedike!

"😭 I wan run. I dey fear. I no know if I go fit handle the diamond deal. I no fit talk no. So, I wan run. I come look am say, how I go fit escape from the palace wey security no go stop me. Na why I talk to her. But she talk say, before she go help me..I go sleep with her. No be say I wan do am intentionally, I swear 😭 😭

Titilope blow breeze, stand and walk away from the table.

"Ade, are you stewpid? Like, are you daft!" The last corper wey dye. Na greed kill am. No be any other thing. You wan dye poor!? This na chance to change your family history. 40% cut from raw diamond wey you no get business with how dem refine am. Your own na just make your 40% cut dey land. Wetin be your problem? You wan run. You wan run away from the diamond, from me? Me? Probably the most beautiful and influential woman wey you don ever sit with. And she is even dying to have you lay with her"

Adedapo sigh and drop his head. E be like say trutru ano geht sense? Why he no think am like this? Na upbringing cause am. Him parents na people wey always believe in good morals, legit income and proper ways of doing things.

"Did you tell the police this"?

"No 😒 Na why I send for you. Anofit tell them say I wan run. Dem go ask say why? How I wan tell them about the diamonds"?

Titilope smile. "You no dull after all. You just dey pretend. Stand up"

Adedapo sigh and stand.

Titilope walk to him and stand very close to him. She fess grab him balls gently and begin to moan.

"Shud I take you home"?

"Ah..if they agree...I wan go home"

"Home...which home"?

"Your place...Arinlu...I wan stay. Am ready, now"

"Really"?

"Yes...mmmm" Adedapo moan as Titilope don dey comot him belt with both hands as she dey stare at him, eyeballs to eyeballs.

Titilope move Adedapo backwards to the wall, till Adedapo back rest on the wall.

He open the belt and drop down his trouser. She begin cuddle him kpoko, dey look Adedapo eyeballs to eyeballs, still. Adedapo no fit control himself again. He grab her head and drag her closer to him own face, begin kiss her.

He wan doke her taytay, but he just dey fear the unknown. Na high class babe, wey still come clean, fine well. Nobody go even believe say na from Arinlu she come from.

Titilope comot her mouth, come do 🎢forst of forst abi na forst of all, wo anyone...sha...go down low!🎢

Adedapo poko don dey ready. Titilope skills pass Adijat one. Adijat dey do am like say na lollipop, Titilope dey caress am like say na sweet bogo meat wey you no fit chew or swallow and you no wan trowey...wha da sheeet sweet pokolee!

Adedapo wan craze. For him head, he don travel enter space, dey see angels...na until he feel am say him poko head dey touch something wey be like kpekus door. He open him eyes, look him front. "Ehhhh! Achalugo don set yash! Better 3:30pm. She rest her hand for table. Her gown don dey her stomach level, exposing the wide, meaty, bombolicious, fresh, stretchmark-free scenting yash! She set am in a way wey be say he dey see the intoto and intete. The thing just dey smile at him, dey invite am. He fess use him pocolee take beat the meat like three times, like say he dey knock, piuuun! Titilope know say something enter am. She do hmmmmm..

He fess dey do am like beginner. But when he reach gather momentum...

*************
The policemen stand for door, dey look time, dey frown. All of a sudden, dem begin hear "kpos! Kpas!ahhh!awwwn!kpos!kpas!

Both of them look each other like "Wha dat bussheeet!" Az how na!?

***********
They arrive back inside the palace. Both of them step out of the car and walk towards Titilope building. Dey open door and enter. Adijat dey set table.

"😁 Welcome ma"!

"Jesus!!! Jesus! Adedapo scream and jump back.

"😁 😁 What? Why you shout like say you see ghost?...Adijat, no worry, go to your room. I will serve the food"

"Yes ma"

"Rule number one, never try to run. Rule number two, never ever reject me again, rule number 3, we fit make you or destroy you. Know these things, and know peace. Come, make we go clean up, so that we go fit eat. We are going to the palace later tonight"

Adedapo no fit close mouth...

To be continued...

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite

Photos from Adecanwrite's post 21/06/2026

I dey come back from site, when I jam one magician for Ikotun wey people surround. No juju wey e no get. I come use style wait make people comot, ask am say shey e geht juju wey be say I fit use, wey be say anything wey I do for my parents, dem no go ever vess or beat me again. E say e dey.

Naso e sell am for me oh for #50. Na powder wey dey inside nylon. E talk say when e remain small make I reach auz or maybe inside compound make I rub everything, make e no remain oh. Say make ai enter house, make my parent be the first people wey I go talk to. I say if dem no dey nko? E say if na one of them, fine, make I go meet am, tell am wetin I want, with confidence. But if any of them no dey, juju don spoil.

I come dey pray. I enter compound, tiptoe go window go peep. I see my parents for sitting room, side by side, dem dey watch tv dey laff. I say Ope oh. Naso I rub the powder, I massacre my face say today, it shall end.

Naso I open door, with vess. March enter, to my parent front, stand for their front like πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡(Image 1) My parents look each other, come look me like πŸ‘‡πŸ‘‡(picture 2) as I shout say "Mummy! Daddy!...make I talk the rest. My papa gbegbanu funmi!(Slap me hard)

The thing sound like "Kpof!"

I just see say pesin off light, on am, off am, on am, off am. Everywhere come dark. E come be like say I dey float. I come feel am say something hit me for body and head. After oh, E come dey clear small small. I see say I don lie for ground. Az how? I stand up make I look my parent, my papa don arrive with blabla.

I do πŸ‘‡πŸ‘‡(Picture 2) Oh my God!...the rest na history!

My papa use me preach on Sunday say I wan use juju for am, make e no dey beat me again. Say make I stand for front of church, tell the church wetin apun.

"Kai! 😭 😭 😭 The most embarrassing day of my life.

"Are you deaf! Tell the church"

"😭 😭 I buy juju powder for Ikotun for #50...

Church burst laff.

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing

Adecanwrite

21/06/2026

Today na Father's Day and I wan celebrate my late father. Happy Father's day, daddy mi ❀️ ❀️

This picture na the last picture wey I snap with am before he passed.

Though you no dey here again, but the values wey you teach me, the discipline, strength and love wey you plant for my life and the lives of my brodas, still dey guide us every day.

I know say if you dey alive today, you for dey smile at my stories dey say "Daaaapo!" The way you used to call me, and you go see how far Adecanwrite don come because of the support wey these lovely people here, dey give me.

To honor my late father, I wan appreciate the amazing people wey dey support my page consistently. Meta Algorithm don help me select some loyal followers to appreciate under this post.

1) Thanks to all my Facebook Subscription and Whatsapp Vip πŸ’Ž members. I comot cap for una. Thank you for loving my work and supporting me. God bless you abundantly. Una be the real VIPs. Una no go ever fall lailai. 🎡 Loke loke lola kunfayakum πŸ•ΊπŸ•ΊπŸ•ΊπŸŽΆ

2) Meta Algorithm don pick the following as people wey don support me for months straight! And others wey algorithms no pick. I also comot cap for una. Who be Adecanwrite without God and you people?. Una too much. 🎢 Loke loke lola kunfayakum πŸ•ΊπŸ•ΊπŸ•ΊπŸŽΆ

I have also decide to pick the top for complimentary access to my WhatsApp VIP Community. πŸ’Ž

πŸ† One Month Free VIP Access:

Oladele Sunday

Munirat Ogundele Azeez

Oluwa Tobi Loba

Okike Precious

Olalekan Abiodun

🎁 Two Weeks Free VIP Access:

ObΓ€fΔ•mi AwolΓΈwΓ΅

Abdullateef Fatokun

Benjamin Tenabe

Temmy Akintola

Sam O'seun Ademosu

Congratulations to all the winners. Kindly send DM for further instructions. Thanks.

And to everyone wey dey support, read, comment, react and share my content, thank you. More opportunities still dey come. ❀️ Trust me.

Happy Father's Day to all responsible fathers out there. And to those of us wey dey remember our fathers today, may their memories continue to bless us. πŸ™ And to those wey don reach age to marry and born, wey never marry or born, God go do am for hs oh. For those wey they look unto God for miracle, because you see this post today, God will answer you. AMEN!

Adecanwrite

20/06/2026

Back then wen my family dey go tru difficult times. We dey owe one woman wey dey sell raw foods, provisions, snacks and so on. We don collect credit from her, taya.

Na me, my papa dey always send to collect the credit because I dey outspoken. Infact when u see me u no go fit say no. The way I go dey look sef. At a time, she come say no more credit. And no money to pay. To chop, come hard for us.

We begin pass another street to avoid the woman, since money never dey. No be say my papa no wan pay, he no get. Infact since she say no more credit, hunger wan kee us.

SAPA press awa neck, wan choke us to death. Kai!

One day, she come our house. My papa quick hide. She shout for my mama, insult her life. My mama begin cry, dey beg her say make she no vess, say we go pay her. Omoh, she rubbish my mama. And me and my brodas dey there.

After she go, my mama no stop to dey cry. My papa come dey beg her say na him fault. My mama say make we leave Lagos go village. Say this suffering and embarrassment too much for her. My papa say no.

We dey there dey watch. Who no go cry, when he or she see their mama dey cry? And the papa too dey drop tears...Who?

Na cry we take do dinner. We cry till we sleep.

Still, things no change. My papa dey try to pay the woman. But the little money wey e dey see, no even reach us chop. How e wan pay debt?

About a week later, we dey go church one evening. We never chop any better food that day. Na pawpaw we chop.

Naso this woman and her sons wey don big, block us for road. She ask my papa for her money. My papa and mama dey look. Naso she begin shout. People begin gather. People begin beg her on my parents behalf. She no gree oh. She say we owe her we go dey buy things from another place. And na lie.We get garri lebu for house wey dem dash us.

Aldo, things like sugar, she dey sell, but na chemist ah dey buy.

Naso her sons carry me oh, say if my papa no pay, she no go release me. Normal, my papa go kee those boiz in three minutes. Na trained boxer him be. But religion and shame turn my papa to mumu. And he dey quick cry for anything shame. Na my mama still dey talk say make she please. My papa just hold waist dey shake head, dey drop tears pro pro pro.
Naso dem carry me oh. My parents come dey follow them for back. Me, I no even talk. I do like Isaac. My brodas begin cry. Few people too follow us.

We reach the woman shop, naso them put me inside shop, lock me inside.
I fess begin cry. Naso the spirit of God tell me say "Dapo, are you stewpid? I bring you inside paradise, you still dey cry"

I first ask myself say, "Paradise as how"? Naso I look around. Omoh, my eyes clear. Tru tru na inside paradise oh. No be eatebles full everywhere like this? Jesus Christ of Nazareth.

I fess attack Digestive biscuit. Fraa! Fraa! Fraa!I don chop three finish. I look oh, see where dem arrange cutleries. I carry cup and spoon, take water, carry eruku oshodi(tea) take milk. I do tea. I carry #12 bread. Naso I sit for ground begin chop like ape.
Dem dey talk talk outside, I dey chop chop inside. I come dey rush am. Because dem fit open door anytime. People dey beg the woman. I come begin pray make she no gree yet. As God will have it, I finish my food. Ehn ehn! I come gauge! I drink the tea well well, use water rinse the cup, drink am too. I return the cutleries.
Yes, now, make I face my people. My parents like bread and Geisha. I pick one #20 bread, two geisha, two eruku oshodi and two milk, put am for black nylon.

The nylon no go contain two bread. I move to snacks. I carry biscuits, kulikuli, groundnut, ekana gowon, tamfiri, chewing gum, baba dudu etc, for pocket.

My two pockets come swell up. And the pockets big well well. Na my papa trouser wey he cut, use do three quarters for me, wey i use rope hold. So, e geh space well well. i pour garri for small nylon, tie am, put am for pocket. Ehn ehn! I don set.

I come sit, dey wait. After oh, dem open door. I stand up, walk to the door.

The woman fess think say she see Votron! 🀣 🀣 Wey my pocket swell up like anything. Ano fit waka well sef, because he dey heavy my laps. She fess look ground, see bread nylon, milk and eruku oshodi nylon. Mama fess shock. She say mogbe oh! For my mind, I do kini? U never see anything! She drag me outside.

Everybody begin look me. My parents shake head say chei, this boi.

She say shey I chop inside her shop? I say yes. She shock. Others burst laff say this boi na giran oh. Naso she collect the nylon say who get this one? I say na for my parents, say dem never chop.

Everywhere fess quiet. She touch my pocket, shout Jesus! She begin bring out everything from my pocket. Ahhh! People begin marvel say okokobioko! Who get all these ones?

I say "😒 😒 is for my brodas. I don chop, dem never chop"

"She say where I chop? I say na for inside her shop"

Everyone πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing

Β© Adecanwrite

20/06/2026

β„’

Please sharing my story does not mean you stole it. It is different from when you copy it,remove my name, post it on your wall and put your name as if na you write am. But, when you help me share, my page name still dey show. It helps to let more people see my story and follow me. Biko, kindly react, comment and share. God bless you as you do that.

: PLEASE, THIS STORY IS RATED 18+

"Can I think about it? You fit give me time to think about it"? Adedapo ask the king.

The king look at Titilope, then back to Adedapo.

"Well, you can. But you stay here, in the palace, and think about it. Take your time"

The king stand at once and head towards the door. The chief and the bodyguard walk after him. The three of them leave the room.

Titilope also leave the room.

Adedapo sit down there dey look. He begin think. E be like say, na end of the road be this for him oh. He need to go back to Lagos. No be by force to serve.

Door open and Titilope enter.

"Are you alright"? Titilope ask.

"Yes"

Adedapo First wan open up to Titilope, say e wan japa. But he quickly caution himself. He know say no matter what, Titilope no fit support am lailai.

"Are you sure"?

"Yes"

"So, the king talk say make you stay here, till you decide. I go tell someone to prepare the visitor's room for you...aunt Adijat! Shey food never ready ni"?

Aunt Adijat walk quickly into the room.

"E remain small, ma"

"Be fast now"

"Yes ma"

"Ade, feel free like say you dey house. If you wan play game, watch tv, listen to music, anything whatsoever, go ahead. When they finish clean the visitor's room, ago let you know"

"Alright"

"I dey upstairs"

"Alright"

Titilope walk upstairs.

Adedapo stand. He walk to the forst window to see if he go fit see the entrance gate into the palace, he no see. He walk to another window and raise the curtain, same thing. He walk to the last one and raise the curtain. "There you are! The entrance gate!"

Aldo e dey far from the building where him dey, e dey see am clearly. Na the same number of security mount there. Three soldiers and two policemen. Then other palace guards still stand everywhere for the compound. He needs to escape. He needs to. Even if it means he will lose his bag, because him bag dey Arinlu.

"Your food don ready sir" Adijat call out. Adedapo drop the curtain and turn at once.

"Okay, thank you" Adedapo reply. Him belle begin sing at once. He come remember say tru tru hunger dey waya am. He never chop since morning. He walk quickly to the dining.

"Make I serve you sir"? Adijat ask.

"Okay"

Adijat begin serve the food. Adedapo come stare at Adijat. And the babe no bad oh, she just big and her Abbobies too big. He big pass him head. But what if he use this babe escape? This babe fit give am idea on how to leave the palace secretly.

After Adijat serve finish, she ask "I fit dey go sir"?

"Wait"

Adedapo look around. "Na you go clean the visitor's room "?

"No, sir"

"Who"?

"Tayo"

"Tayo? Where she dey"?

"Na up, she dey work. She dey upstairs"

"Okay...okay.."

"Make ai dey go, sir"?

"No, wait. I need your help"

"Okay sir"

"But no be wetin I fit talk for here"

"Okay sir"

"You fit come visitor's room, later"?

"Ahhh .."

"No be you talk say you fit keep me company if I dey bored"?

Adijat smile. "Ano know say na that one..ehn but sebi you dey go house later. You fit just come my place, stay first"

"No. Na here I go stay today"

"Why"?

"Na the king talk am"

"Oh..I see. You be king visitor. If dem catch me for your room, dem fit sack me"

"But you know your way around here now, don't you? You go fit sneak in now, wey be say nobody go see you"

"Hmmm...okay, ago try. But, no lock your door oh"

"I will not. Thank you"

"Thank you too 😊

***************
Adedapo shower well well. He lie for bed. He wear boxer and the pyjamas wey he meet for the room. He dey press phone. Him mind no comot for the wall clock. And he dey try keep himself awake. If he see say him eyes wan close, he go stand, stroll around the room.

Suddenly, at around 11:45pm, he hear sound for door. He walk to the door and open it gently. There stand, Adijat. She wear one free flowing gown.

"Come in" Adedapo whisper. Adijat walk in, and Adedapo close the door.

"😊 Good evening sir"

"Good evening. Come"

They walk to the bed. Sit down"

Adijat sit.

"I like you very much"

"Is a lie"

"Am serious. That time wey you come meet me. I no get myself, because I wan see the king for a very important matter. But after I don see am now, I feel okay"

"😊 😊 Okay, ah don forgive you"

For Adedapo mind, e be like "werey nseleyi o"(wetin dey worry this one"?)

"😊 Thank you. Before we get to business, he get wetin I wan tell you"

"Wetin be that"?

"Promise me say you no go tell anyone, and you go do am for me"

"I risk my job to come here. My dream job. So, why not?"

"The thing is that, e get one document wey I suppose give the king wey him suppose sign for me. Na tmao noon he wan sign am. I tell am say he dey with me, but the truth be say,ah no remember to carry am, from where I sleep for Ondo town. So, I wan quick go early in the morning before Titilope go even wake up, make ai come back. You know aw ai fit comot for palace wey she no go know? You know say security fit dey ask me questions"

"Hmmm..na lie you dey lie. You wan run away"

"😲😲Ahhh!"

"Yes. You no forget anything. You wan run away"

"Why...you think say I wan run away"?

Silence.

"I know about the diamond for Arinlu"

"😲😲You do"?

"Yes. Ma for phone conversation I hear am. I don dey work here for 13years"

"Wha da sheeet! Did anyone know, that you know about the diamond"?

"No. Anofit tell anyone oh. You wan kill me 😁. And again, I hear everything wey the king tell you"

"You dey eavesdrop on us"?

Adijat shrug. "Na so I find out about my boss chopping the work of my fiance"

"I see. Okay, yes, ah wan run. Ah no fit do wetin they want make I do. And if I say no..."

"(Cut in) You no fit oh. No even try am. Na the best option be this. Just run"

"So, you go help me"? Adedapo ask.

"Mmm...e hard oh. Lemme think first..."
*******
Titilope sit for one chair, dey watch one CCTV video for her laptop. She dey play am back. Each time she watch, she gets angrier. At a time, she smash the glass cup of wine in her hand, to the wall, walk away from the laptop, hold his head with both hands and scream. She dey stark naked.

"😑 How dare him!? How dare she!"?

The video start again. We see Adijat walking slowly towards a door. She knock and wait. Door open and we see Adedapo. Adijat walk in and door close...
**********
"I get one idea" Adijat finally break the silence.

"Share it, please"

"The prince, Prince Okanlawon, dey always run club inside the palace, everyday. He dey always bring his friends. Na very early the next morning, dem dey always leave. I fit run am, make you follow the friends comot"

"Are you serious"?

"I dey serious. The prince like me. Na me dey cook for am before they move me here, my dream job. No stress with better pay. Stress dey that side"

"Wait, so you mean you go talk to the prince and then when him friends dey go house in the morning, ago follow them"

"Exactly"

"😊Thank you"

"Don't mention. I will go and see him when we finish"

"No, go now. The earlier the better"

"But we never finish"

"Adijat, we fit do that one later now"

"No, no later oh. We do it now"

"Okay then"

Adijat giggle and stand. She remove the gown from her shoulder and it drop on the floor. Adedapo never seen that kind water melon bobbies before. And they dey full, stand gidigba for her chest like say dem mould am. She walk close to Adedapo and kneel. Adedapo just stand there. She open the pyjamas and pull down his boxer. Adijat fess gasp when she see the size of Adedapo burantashi.

She fess cuddle am small, make the thing fit stand well well. When e don stand, she gulp am with her lips begin do am like say she dey lick stick sweet.

Adedapo leg feas vibrate. He no know when he pull off the pyjamas. Pyjamas drop for ground. He first face the ceiling. When the sweetness hit am well well, he look down, grab Adijat head.

Adijat continue to do her thing for about ten minutes, before she stop. She stand, walk to the bed, climb and set herself like 2:15pm /_

Adedapo walk to the shelf, open am, begin check, maybe he go see rubber. E no see. Him body dey shake. He check the second one, nothing. He check the third one, nothing! "Sheeet!" He walk to the wardrobe and open it. He scan tru with his eyes. And there it is! Lucky him! A pack! He carry the pack and open it. Two satchets remain inside.

"Oh boi, dem don fok taya for this room, if one pack fit remain two satchets. That one no concern am at this moment. He cut one satchet chap chap, wear am.

He walk back to Adijat. He fess use hand take rub the snail antenna wey dey there. Adijat begin sound like cat. He continue for sometime, till everywhere come begin do medemede, pishipishi. Baba slot it in like say na SLOT!

He fess dey go in and out slow slow, but he dey reach down down, dey go all in. Adijat dey feel am, especially when he dey inside. He do am slow and steady for like 5minutes. After that, he come begin increase the pace. At a time, he come turn to war. "Kpas kpos! Kpos! kpas!

Adijat wan tear bedsheet, infact she wan chop am. As Adedapo dey pound, her body dey vibrate jobo!jobo! Her backyard dey clap.

Na Adijat fess arrive. She shout like say her spirit wan comot from her body. Her body vibrate, she choke. Adedapo no stop because him sef don almost reach bustop. As Adijat dey get herself na him Adedapo too come arrive. By then, everywhere don stew.

Two of them first rest small, they come enter bathroom shower. As they enter room back, Adijat wear her dress say she wan go see Okanlawon.

"Flash my phone, lemme give you my number" Adijat talk.

*********
Adijat na Okanlawon insider. Okanlawon know say him papa dey do underground package but he no know wetin he be. Aldo him papa dey give am more than enough allowance. But, he wan dey see him own money. He know say, na everything about him, Titilope know. He fess try to toast Titilope make e use that one enter am. But Titilope say no, say king don warn am, make she no near any of the prince.

He come decide to use Adijat. He first talk to her and promise to dey pay her seperate monthly allowance if she dey give am better intel. Okanlawon come begin complain to Titilope about Adijat, say he no want her. Adijat come tell Titilope say na because she no gree make Okanlawon nack am, na why he hate her. Adijat know say Titilope go pity her. Naso Titilope tell Okanlawon make dem exchange cook.

Adijat begin out ears down. Anything wey she hear wey be better info, she go tell Okanlawon. Some, na recordings. The day wey she first hear about the diamond, she tell Okanlawon. Okanlawon wan mard. Diamond keh!? Adijat dey update Okanlawon wella.

Adijat sneak out of the visitor's room. She come sneak back to her room. She also get room for there if she no wan go house. She change her clothe, sneak out of the building. She head to Okanlawon building. The security just screen her and allow her in.

Party dey go on as usual. Okanlawon dey club every night, except maybe the king order him not to, or he wan write exam, or he sick. Dem no dey pass 20-30, and na just maybe 5-7 guys. Others na gurls.

As she sit down, dem don serve her drink. Them know say na Okanlawon she come see. After like twenty minutes, Okanlawon leave the girls wey him dey with, come meet her.

"Howfar"? Okanlawon talk loud because of the noise.

"The king come yesterday. He discuss the diamond with him. But I never know wetin he want make e dey do for am exactly"

"He no talk am"?

"No, na today or tmao, them go talk that one"

"Okay okay, you sure. Is that all"?

"No"

"What else"?

"Please you fit allow the corper leave with your friends in the morning"?

"How"?

"He wan go pick one document for town. And e no want make Titilope know. He talk say he need the documents for the discussion wey him get with the king later tomorrow. He come to me for help. And you know say, if I fit help him, next time, he go fit gimme info wey I need"

"True. Ermmm...na 4:30am dem dey go, so, get him ready. That one na small thing"

"Really πŸ˜‚?

"Yes"

"Thank you"

"You wan stay"?

"Me keh?πŸ˜‚ Lemme be going"

"Okay, good gurl"
***********
Adijat walk out of the building, and walk to the back of the house. The path dey dark, but na the safest and fastest way back be that.

She first hear sound for her back. She halt and look back. She no see anybody. She continue to go. She call Adedapo.

"Get ready, I go come knock your door by 4:20am, okay"?

"Okay, thank you" Adedapo reply over phone.

Adijat end the call and cornered..as she corner, she bump into a man, wey tall, wear face mask. She startled. As she wan turn, another one dey behind her. The one wey dey back, hold her hands for her back, the one wey dey front, use one handkerchief press her nose...

***********
Adedapo wait for Adijat call, taya. He just dey look time. 5am, 6am...7am..kai! Wetin come happen? Abi they catch her ni?

He enter bathroom, baff, wear his clothe. He never sit down two minutes, when pesin knock him door. He walk to the door and open. He see two policemen. They flash their I.D card.

"Good morning Mr. Corper. Sorry to disturb you, but you are needed at our station"

"Station? What for"?

"Well, when you reach there you go know"

"Am sorry ano fit follow you unless you tell me wetin I do"

The policemen look each other.

"The body of Miss Adijat was found this morning, hanging in her room. And na you she dey with last"

"Wha da busheeet!"

To be continued...

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite

Want your public figure to be the top-listed Public Figure in Lagos?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Category

Telephone

Address

Lagos